Grow Up and Get the OT of Life – Abobi Eddieroll Blast Bayelsea Entertainers

Grow Up and Get the OT of Life - Abobi Eddieroll Blast Bayelsea Entertainers 1Paddymen How E dey Be?

So finally,
All these my Brothers for Bayelsa
WETIN BE MOST OF UNA PROBLEM?

Now the Screenshot na Caprisonne between My Tshirt n Artiste for the Bayelsa wey even Come from my Village o, The other day him see me, dey hail me like say Him see Wizkid, I lockup, Now today, that same nigga dey advice my TSHIRT just because say she post my work n play my song.

Like seriously ehnnnn, some of una suppose dey happy say i no Join this cult finally o, If not, i for don pull up on una sorry ass.

With niggas broke all una teeth dem
The painful part b say no be the First person, dem plenty, like whats your Business with how dem play my song? E concern you?

Why una never Tell Drfish The same thing?
If una wan Oil the TSHIRT sef, una no gats bring me down for that one cos most of una.

As una shoot shot, una shot knack bar, una go turn Special Advisers begin cap fire.

My songs are being played Across the Niger Delta atleast i hold my ground.. And that is the work of my TEAM, People who devoted their time to make sure we make something out of Nothing..

YOU MAY ALSO LIKE  247E!News: Jeffiraino talks album plans, featured artistes, soon to drop single... etc ∫ @jeffiraino

If na to Carry woman, been there, done that, No be to dey carry Bayelsa girls, concentrate on Building your career, Focus your energy.

If the next man dey shine, stand near am make him light touch u small n that’s exactly what m doing i don’t go about trying to bring people down or gossip like you niggaz do I mind my biz n y’all should mind yours.

I dey Inside car with Yawngboss when Kayswitch call me say him go like Involve for the “WIDA YOU REMIX“.

I drop that remix, 70% of una no shake body but Thank God say the numbers dey climb.

Na God dey On person light, to say una Get port harcourt OAPs their number, i believe say una for don buzz dem too.

And trust me, I no Holy, i no be Saint, I dey smoke, drink, probably like woman pass all of una sef but one thing i dont mess with is my “CAREER

I won’t even b with a Woman who doesn’t support my career in anyway, even friend wey no go support my career, i no wan get so if e dey pain you say people around me dey go out of their way to promote my brand

YOU MAY ALSO LIKE  SEXY OR TRASHY!!! Timi Dakolo Rocks New Hairstyle

My Guy drink Sniper, before over thinking go kill You…

Even if dem Begin Keep steady Light for the Bayelsa sef, Some of una go still dey live for Darkness because hatred no go allow Light shine for una side.

Once person reign small for the small town, una go begin Gossip, Dey judge from afar instead of to gum body get your own compass.

E dey pain me say na Artistes dem dey do this thing pass
WHY TIMAYA no go AVOID UNA? Una way of thinking is too Shallow man, Y’all need to grow up n Get the OT of life..

“DEY YOUR LANE, THE NEXT PERSON, HAND MUST TOUCH YOU”
Anybody wey wan behave like PIG, we be street boys o, We no dey fear MUD.

#WOLF_PACK
#ABOBIMOVEMENT
#WIDAYOU
#TESTED